Rockol30

Testo If Dey Crase ft K-Switch - D'Banj

Testo della canzone If Dey Crase ft K-Switch (D'Banj), tratta dall'album 51Lex Presents If Dey Crase

If you dey craze
If you dey craze
If you dey craze
My brother no bring craze come my side
Cause when craze meet craze, craze go high
You, better make you chill, make you hold your side
If you dey mad
No bring your madness come my side
Cause when mad meet mad, mad go high
You, better make you chill, make you hold your side
You get your own money, i get my own too (true)
You get your own baby, i get my own too (true)
You get your own problems, i get my own too (true)
You say you get werey, i geti pass you
I dey my own for front, dey chill with my crew
You come dey scope my baby, my one and only boo
Your eye one comot, na she you wan do
Make you add join your own, na make you get two
I no wan believe say, na Oju kokoro
Wey your eye dey red like you don jogodo
Na small thing una men dem go pull shokoto
Co-co-comot for hear, with your small tololo
As you dey stand for there dey form i too good
You see now your plan backfire on top you
I dey carry your babe waka, you be like mugu
Na you do you, shabi i warn you
If you dey craze
My brother no bring craze come my side
Cause when craze meet craze, craze go high
You, better make you chill, make you hold your side
If you dey mad
No bring your madness come my side
Cause when mad meet mad, mad go high
You, better make you chill, make you hold your side
Your blood don da hot, you carry bottle
You wan try provoke, i no-go touch you
You touch me for chest, i still respect you
As a peace ambassador, i no-go fight you
I know say you strong, i no da doubt you
Dey don tell me many things about you
Yes i don hear, all the things you don do
Make you hold that level, abeg i don do
Because you be the man, you come dey form ikuku
You say my eye dey red like i don jogodo
I no be cocolet, i no like koboko
And na who tell you say, i get small tololo
You come dey rake for there since quarter pass two
I don arrange Mopol, to come arrange you
Dem da carry you waka, you be like mugu
Na you do you, shabi i warn you
If you dey craze
My brother no bring craze come my side
Cause when craze meet craze, craze go high
You, better make you chill, make you hold your side
If you dey mad
No bring your madness come my side
Cause when mad meet mad, mad go high
You, better make you chill, make you hold your side
Dem ma chat, dem ma yarn like a bad man
Make we use the one fit come, act like a hard man
Pause on a breadi like, say dem ma animal
Till the bull lets stopping body, middle on your heart man
Next morning your mama is mourning
A liku boy dey act like a dogi
Tell me why dem fight, cause early cool morning
Johnny so sorry cause johnny on a journey
You see my craze dey calm craze
And craze fit make your craze find hiding place
Because i no violent, no mean sa na disgrace
Cause Johnny kain craze, na em end am oh for grave, for grave
Calculate the damages, some of dem need bandages
Plenty are fit dead, check the internet for images
You live to this world, you die to this world
And i definitely know you cannot this
If you dey craze
My brother no bring craze come my side
Cause when craze meet craze, craze go high
You, better make you chill, make you hold your side
If you dey mad
No bring your madness come my side
Cause when mad meet mad, mad go high
You, better make you chill, make you hold your side



Credits
Writer(s):
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link

Disclaimer: i testi sono forniti da Musixmatch.
Per richieste di variazioni o rimozioni è possibile contattare direttamente Musixmatch nel caso tu sia un artista o un publisher.

Elenco artisti

© 2025 Riproduzione riservata. Rockol.com S.r.l.
Policy uso immagini

Rockol

  • Utilizza solo immagini e fotografie rese disponibili a fini promozionali (“for press use”) da case discografiche, agenti di artisti e uffici stampa.
  • Usa le immagini per finalità di critica ed esercizio del diritto di cronaca, in modalità degradata conforme alle prescrizioni della legge sul diritto d'autore, utilizzate ad esclusivo corredo dei propri contenuti informativi.
  • Accetta solo fotografie non esclusive, destinate a utilizzo su testate e, in generale, quelle libere da diritti.
  • Pubblica immagini fotografiche dal vivo concesse in utilizzo da fotografi dei quali viene riportato il copyright.
  • È disponibile a corrispondere all'avente diritto un equo compenso in caso di pubblicazione di fotografie il cui autore sia, all'atto della pubblicazione, ignoto.

Segnalazioni

Vogliate segnalarci immediatamente la eventuali presenza di immagini non rientranti nelle fattispecie di cui sopra, per una nostra rapida valutazione e, ove confermato l’improprio utilizzo, per una immediata rimozione.