Testo Baby Mo - Styl-Plus

Testo della canzone Baby Mo (Styl-Plus), tratta dall'album Legacy

Ai, baby, no
Styl-Plus io, eh
She wan chop this our money
Our money io
Baby mo, omo mo be so
You wan play me wayo, I no be oyinbo
You no fit chop my money go
You no fit carry my ego, oh-oh
You no fit chop my money go
You no fit carry my ego, oh-oh
Wetin my eye don see o
If I talk am e go hard to believe o
The matter come dey make me dey wonder
Whether the thing wey dey worry the girl na long throat or hunger
Because e meet me for Park 'n' Shop io
E think say e go take me chop io
E wan turn guyman to mugu
You can't turn Urhobo man to mugu
Baby say e dey hungry, I say I know
I take am go Iya Basira place o
She look the place she say nawa o
Me sef I tell am
Baby mo (baby mo), omo mo be so (no)
You wan play me wayo, I no be oyinbo
You no fit chop my money go (chop my money go)
You no fit carry my ego, oh-oh (you no fit carry my ego)
You no fit chop my money go (you wan chop my money go)
You no fit carry my ego, oh-oh (you no fit o, not my ego)
Wetin I see with my eye o
If I talk am you go say I dey lie o
The matter come dey really confuse me
I dey wonder if she dey gbadun my style or she just wan use me
Because she meet me for one nightclub io
She come dey find as she go take me chop io
The baby think say she dey fast
Tishe Luku no dey ever take last
Baby ask for shoe, I say, "Yes oh"
I take am straight to Tejuosho
As we reach the place she say nawa o
Na so I tell am o
Baby mo (nwa mmo), omo mo be so (haba, haba!)
You wan play me wayo (wayo), I no be oyinbo
You no fit chop my money go (baby mo)
You no fit carry my ego, oh-oh (you no fit carry my ego)
You no fit chop my money go (you wan chop my money, no, no, no)
You no fit carry my ego, oh-oh (lekwa nune chichi o)
Whether dem like am o, whether dem dislike am, oh-oh
The thing be say e don dey tey wey I know say dem wan chop my money
Dem dey look me like Obama, dey find how dem go take me hammer
The thing be say they don forget say I grow for Naija not for Yankee
These girls dem no know me, omo ile oluji
She manipulate me and separate me from my money
E no easy o, you go lie, you go cry, you go try
But e no easy o, baby, baby mo
Baby mo (baby mo), omo mo be so (omo mo be so)
You wan play me wayo (wayo), I no be oyinbo
You no fit chop my money go (you no fit chop my money)
You no fit carry my ego oh-oh (no, no, you no fit carry am go)
You no fit chop my money go (eh, baby, emi)
You no fit carry my ego oh-oh (moti soji, iwo gan oje soji)
Baby mo, omo mo be so (no)
You wan play me wayo (no), I no be oyinbo
You no fit chop my money go (my money go, go, go, go)
You no fit carry my ego oh-oh (my ego-go-go-go)
You no fit chop my money go (my money go, go, go, go)
You no fit carry my ego oh-oh (my ego-go-go-go, no)



Credits
Writer(s): Akintunde Babatunde Akinsanmi, Shifikovie Adogho Emoefe, Olasunkanmi Omolaye, Zealous Onyecheme
Lyrics powered by www.musixmatch.com

Link

Disclaimer: i testi sono forniti da Musixmatch.
Per richieste di variazioni o rimozioni è possibile contattare direttamente Musixmatch nel caso tu sia un artista o un publisher.

Elenco artisti

© 2026 Riproduzione riservata. Rockol.com S.r.l.
Policy uso immagini

Rockol

  • Utilizza solo immagini e fotografie rese disponibili a fini promozionali (“for press use”) da case discografiche, agenti di artisti e uffici stampa.
  • Usa le immagini per finalità di critica ed esercizio del diritto di cronaca, in modalità degradata conforme alle prescrizioni della legge sul diritto d'autore, utilizzate ad esclusivo corredo dei propri contenuti informativi.
  • Accetta solo fotografie non esclusive, destinate a utilizzo su testate e, in generale, quelle libere da diritti.
  • Pubblica immagini fotografiche dal vivo concesse in utilizzo da fotografi dei quali viene riportato il copyright.
  • È disponibile a corrispondere all'avente diritto un equo compenso in caso di pubblicazione di fotografie il cui autore sia, all'atto della pubblicazione, ignoto.

Segnalazioni

Vogliate segnalarci immediatamente la eventuali presenza di immagini non rientranti nelle fattispecie di cui sopra, per una nostra rapida valutazione e, ove confermato l’improprio utilizzo, per una immediata rimozione.